Story book wey dey promote Pidgin and oda language don show

Wetin we call dis Video, "We go dey speak English, dem go dey wonder"
    • Author, Dooshima Abu
    • Role, BBC News Pidgin, Abuja

According to UNESCO, e reach 65 million pipo for Nigeria no sabi read and write.

Dem say dis one no good as e dey land dem for poverty pass pipo wey sabi read.

Wetin we call dis Video, Pidgin sweet to talk but to read am for book na another mata

Because of dis palava, British Council for Nigeria don organise writers to write book for different local languages for Nigeria, Ghana and oda West African kontris dem.

BBC News Pidgin reporter Dooshima Abu say dem translate di books to pictures to help pickins to learn how to read for dia mama and papa language.