"Nobody suppose question why God join us" - Buhari

Nigeria President Muhammadu Buhari

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Buhari promise to make hand of justice fall on top pipo wey dey kill anyhow for Nigeria
Read am in 1 mins

Nigeria President, Muhammadu Buhari farmers and herdsmen go still continue to dey relate, even after e comot for government

Oga Buhari follow different groups do meeting for Benue as to how dem go solve di attacks and kill-kill wey dey happen for di state.

Di persident say "Nigeria get over 250 ethnic groups with different cultures and nobody suppose question why God join us together."

President Buhari, bin do di meeting with Benue State Governor Samuel Ortom, Miyetti Allah Group, farmers for Benue State, and oda joinbodi dem for inside di Government House for Makurdi, di Benue State Capital.

All di joinbodi wey dey bin get opportunity to talk dia mind on di mata wey don kill plenty people and how dem feel say e fit end.

Di Chairman, Miyetti Allah Group for Benue State, Ubbi Haruna talk say im pipo no get hand for di anyhow kill-kill, say na peace dem always support.

"From now on, peace go dey for di state. Make bygone be bygone to allow peace and security to reign," talk Haruna.

Mr Terlumun Akputu wey represent di farmers talk say "More than 160, 000 of dia farmers don turn to refugees for dia own land because of di herdsman attack."

Im come beg President Buhari to support dem with programmes wey go help di farmers to return to life as normal, and recover di farmland wey dem don lose.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Many pipo for Nigeria bin no happy say President Buhari never go Benue since di recent attack bin happen but im get time to go wedding and go follow Ghana celebrate independence. Later di President reply say just because im no show for di places wey katakata dey for Nigeria no mean say im no dey prepare plan to deal with di mata.