Kylie Jenner don release di foto of her pickin Stormi

Wia dis foto come from, travisscott/Instagram
Kylie Jenner and Travis Scott don post picture wey show di face of dia daughter Stormi for di first time.
Kylie, wey be last born for di family wey dey popular TV show 'Keeping Up With di Kardashians', post video of her pickin Stormi for Snapchat, she write for say : Aww! di sweetest thing ever."
Scott sef post di picture for im Instagram come write: "Our little rager."
Di picture don already get 1,627,484 likes for Scott Instagram.
Jenner bin no let pipo know say she get belle until she born, come tell pipo three day after.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post







