Dapchi Girls: President Buhari say im government go free everibodi wey Boko Haram kidnap

Buhari

Wia dis foto come from, Bayo Omoboriowo

Wetin we call dis foto, Buhari don promise say di 110 girls wey dey miss for Dapchi, say government go find dem.
Read am in 1 mins

President Muhammadu Buhari don nack hand for chest say im government go make sure say dem free all di people wey Boko Haram kidnap.

Buhari make dis promise for Presidential Villa, Abuja as im siddon do meeting with three lecturers of di University of Maiduguri and one woman, wey Boko Haram just release.

Di president also do meeting with one policewoman and family members of another policewoman wey die for di hand of di Islamist militant group.

Im promise say di 110 girls wey dey miss for Dapchi, say government go find dem.

Na for July 2017 Boko Haram kidnap di lecturers for Magumeri wey dey for Borno State while di attackers carry ten women after dem attack dia police convoy for Damboa road, near Maiduguri also for Borno State.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

President Muhammadu Buhari say na di negotiations wey di International Committee of di Red Cross help do na im help free di people.

Meanwhile di Federal Executive Meeting (FEC) no go happen dis Wednesday as usual.

Di spokesman of di president, Femi Adesina talk say government cancel di meeting so President Muhammadu Buhari fit go di big meeting of di International Conference on Lake Chad Basin for Abuja dis week.

University of Maiduguri

Wia dis foto come from, STEFAN HEUNIS

Wetin we call dis foto, Di three lecturers disappear since July, 2017