Nigeria: JAMB don suspend staff wey snake swallow N36million from

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Joint Admissions and Matriculation Board, JAMB, don suspend dia staff wey say na snake swallow di N36million scratch card money for dia Makurdi, Benue office.
Philomina Chieshe bin talk say she no sabi where di money dey and na her house help tell am say na 'spiritual snake' chop di money.
Dis one na after auditors go di Makurdi office to torchlight how much money di office don make from di scratch card wey students buy to check dia JAMB result.

Wia dis foto come from, EFCC
JAMB head of information, Fabian Benjamin, tell tori people say dem don dey penalise di staff and security agencies sef don dey investigate di mata.
To add join, e be like say di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, don put eye for di mata because last year, di Federal Executive Council bin talk say dem suppose investigate JAMB.







