Lassa Fever: Edo and Ondo states dem get more cases for Nigeria

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Gombe State government for Nigeria say one person don die on top Lassa fever for di state.
Na di oga for public health, Joshua Abubukar na im tell local tori people dis one.
Im say di 18-year-old woman die for Funakaye Local Government Area.
Dis one dey happen as health official for di country don call emergency meeting for Abuja, wey be di capital, to discuss di palava.
Di Minister of health, Isaac Odewole say Edo and Ondo states dem get di highest number of people wey di disease affect.
End of Di one wey oda users dey read well well
E say most of di states no get better emergency response and good laboratories dem.
Mr Odewole still advise states make dem make sure dem establish better infection prevention committee, to help dem deal with any kain disease.











