South Africa gold mine: Dem don free all di 955 trapped workers

Wia dis foto come from, AFP / Getty Images
Dem don rescue all di 955 workers from one gold mine for South Africa.
"Everybodi don comot," na wetin James Wellsted talk, wey be talk-talk person for di operating firm Sibanye-Stillwater. Im say dem been get some "cases of dehydration and high blood pressure but e no serious".
Na since Wednesday night na im di miners dey trapped for underground.
South Africa na one of di countries wey dey produce gold pass for di world, but people don accuse mining companies well-well say dem no dey try for di safety of dia workers.
Mr Wellsted talk say dem dey try start emergency generator so di lifts go start to dey work again.






