Benue Militia: Government nack N5mn reward for gang leader head

Wia dis foto come from, Getty Images
Benue state government don drop N5mn as dash-money for anybodi wey fit bring information wey go lead dem to one notorious criminal gang leader.
Authorities for di north central state wey don dey battle with communal clashes between suspected Fulani herdsmen and area people say dis gang leader street name na "Ghana."
Tori be say "Ghana" and im gang people bin don dey do bad-bad thing for di state, and wen dem attack Zaki Biam market, na im governor Samuel Ortom promise to give anybodi N5mn to know where "Ghana" dey.
But dat one no work, so dem increase am.
Na di Benue information and orientation commissioner, Lawrence Onoja talk all dis one, after di state executive meeting.
Mr Onoja add say dem don also ban di use of siren, still come order police make dem catch anybody wey cover im motor plate number, as security don dey high for di state.
Soldiers don enter Gboko Town
Meanwhile, troops don land for Gboko, to bring peace come di area, after youths attack some Fulani herdsmen, still kill seven of dem.
Di soldiers bin enter streets with dia truck to show force and dis wan come make di people dey fear.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di army talk-talk person for Benue State, Olabisi Olalekan Ayeni say di dem dey for Gboko to bring peace and not to burn people house, as rumour bin carry am.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Meanwhile, plenty people don enter social media di vex for di way Benue youths kill di Fulani herdsmen:
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3