Fuel scarcity: Smugglers no gree make we guarantee steady supply of petrol - NNPC

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria government oil company don draw ear come outside say smugglers and people wey dey hide petrol na im dey make am difficult for dem to guarantee steady supply of petrol for di country.
Group Managing Director, Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC) Maikanti Baru on Wednesday complain give di country lawmakers say since December 2017, im dey shock say all of a sudden di demand for fuel don pass di 35 million per day reach 55 million yet fuel still no dey.

Wia dis foto come from, Getty Images
Baru tell di Joint National Assembly Committee on Petroleum Downstream say na some bad guys wey dey use corner-corner smuggle fuel cross-border na im dey cause am and if dem no stop dem, di NNPC no fit guarantee say fuel go dey available anytime people want am.
Di Oga in charge of NNPC want make security agencies arrest di people wey dey do di smuggling because dem dey take advantage of petrol price difference between Nigeria and neighbouring countries to make illegal profit.

Wia dis foto come from, AFP
Di cost of petrol per litre cheap for Nigeria pass oda West African countries dem.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Im also want make Nigeria government double supply in order to raise di fuel storage tank back to di 30 days reserve from di current 15 days reserve and dat one go happen by bringing in at least two vessels per day for 20 days.








