You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Seun Kuti: 'Nigeria government never begin fight Herdsmen'
Seun Kuti, di son of Afrobeats legend Fela Anikulapo-Kuti say Nigeria government never serious about di kill-kill wey dey happen for Benue state, north central area of di country.
Im tell BBC News Pidgin say: "I know how Nigeria dey fight person. Nigeria government never begin fight herdsmen di way dem never begin fight Boko Haram."