Niger Delta Avengers don threaten fresh attack to burst Nigeria oil pipeline

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI
Niger Delta Avengers don talk on Wednesday say dem go attack oil pipelines again.
Dem announce am for their website say dis new attacks go bad pass di ones wey Nigerians don see before.
Di militants talk say na deep see operations go suffer pass especially di ones wey belong to Bonga Platform, Agbami, EA Field, Britania-U Field and Akpo Field.
When BBC News Pidgin call di Niger Delta Presidential Amnesty office on top dis matter, dem talk say dem dey aware of dis new threat but say dem go come out with reaction later.
Niger Delta Avengers say di reason why dem wan attack oil pipelines na because dem want Nigerian authority to restructure di country.
Dem say make di oil companies know say dem dey track their operations and dem no go fit escape di wahala wey dey come in a few days.






