Cameroon separatists palava: Fresh wahala dey English speaking region

Di English speaking region of Cameroon wan go form new country wey dem call Ambazonia
Wetin we call dis foto, Di English speaking region of Cameroon wan go form new country wey dem call Ambazonia
Read am in 1 mins

BBC News Pidgin dey monitor situation for di English speaking region of Cameroon after panic and fear make people dey run left, right and centre on Monday.

Di panic make student dem begin scamp run comot from schools for di area.

Wetin cause tension na tori say e be like say separatists dem wey wan break away go form another country, kill one Special Forces officer inside Dian, wey be town for south-west region.

Di thing be be say for di past one year, serious tension dey inside south-west and north-west region for Cameroon as people don dey complain how dem no dey treat dem equal for matter wey concern economy and social injustice.

Now Schools for dat area no open on Tuesday.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post