5 things wey some men dey do to 'slay'

Wia dis foto come from, NELSON ALMEIDA/AFP/Getty Images
Di idea say na only women like fashion and wan fine na old gist. Men no dey carry last.
Today wey how people see you dey important and many people fit relate with you based on how you look, men too don dey do wetin dey necessary to stay fine.
Some men don even go extra miles to do some kind things to dia body to 'blend'.
Penis bleaching

Wia dis foto come from, LELUXHOSPITAL
Penis bleaching dey make waves today for Thailand.
Although bleaching no be new thing for di Southeast of Asia, dis new trend don carry things enter another level.
With di penis bleashing, people wan "fine" or "white" for everywhere and dem believe say white private part dey fine pass.
Six pack

Wia dis foto come from, PATRICK BAZ/AFP/Getty Images
As some men dey carry sweat full dia bodi for inside gym to get six pack, some go just pay money do surgery.
Dimple
Plenty men dey do dis surgery to make dia smile more attractive.
End of Di one wey oda users dey read well well
Pink Lips

Wia dis foto come from, JarateJarate
Who tell you say na only women want pink lips? Some men too want am and dem go anything dem fit do so dem go get am. Dis trend dey happen for countries for Africa too like Nigeria.
Eye Tattoo

Wia dis foto come from, YASUYOSHI CHIBA
Okay so dis wan na for people wey love tattoo, some men dey tattoo dia eye to any colour dem want. Women too fit do dis wan.










