Boxing Day aka beach day for Lagos

Lagos Beach

Wia dis foto come from, Helen Oyibo

Wetin we call dis foto, For Nigeria, Boxing Day na another day after Christmas to 'hang out'
Read am in 2 mins

December 26 wey be Boxing Day, na di day after Christmas but different tori dey about how di celebration take start.

One tori say e start for UK, for olden days when servants of rich people dey get di day off to take visit dia family as dem dey work on Christmas day. Dia oga go give dem box wey contain food and gifts to carry go.

Another tori na say on Boxing Day people dey wrap gifts for box give all di people wey do dem good during di year.

Anyhow e take start, one thing wey people wey start am carry for mind na to give and receive gifts on Boxing Day.

But e be like say for Lagos Nigeria, Boxing Day for some people na to jolly for di many beach dem wey dey di city.

Huntsman and hunting dogs.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Na also day for some people to hunt for UK
Shoppers for Oxford street UK

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For UK na serious shopping dey happen on Boxing Day because of sales.
People for beach.

Wia dis foto come from, Helen Oyibo

Wetin we call dis foto, People full beach for Lagos on Boxing Day
People dey swim for beach

Wia dis foto come from, Helen Oyibo

Wetin we call dis foto, Plenty ways na im people dey catch fun for beach inside di water, whether na to swim or play ball
Couple sit down close to di water for beach

Wia dis foto come from, Helen Oyibo

Wetin we call dis foto, Bonding dey also happen for ontop water.

For dis Nigerian man and im family sha, Boxing Day na to watch di 'real' thing.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post