UK: Prince Harry and Meghan Markel go marry 19 May 2018

Wia dis foto come from, AFP/GETTY IMAGES
Prince Harry of Wales and US actress Meghan Markle wedding go happen on Saturday 19 May 2018, Kensington Palace don announce.
Di couple wey confirm their engagement last month don say St George's Chapel, Windsor Castle na di venue of di wedding ceremony.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di Royal Family of UK go pay for di wedding, including di service, music, flowers and reception.
Kensington Palace also confirm say di couple go dey with di Queen for Sandringham, during dis Christmas period.
Di wedding na on di same day wey dem go play FA Cup final, wey im brother Prince William suppose attend, as im be di FA president.






