Five scientist don win $100,000 NLNG prize

Wia dis foto come from, Getty Images
Chairman for di Advisory board for di science prize for Nigeria LNG Limited (NLNG), Professor Akpoveta Susu, talk say five winners don show for dis year.
Im say dem select di five winners from 27 oda people wey apply for di award.
Ikeoluwapo Ajayi, Ayodele Jegede plus Bidemi Yusuf join-hand win for dia research work, wey dem call, "Improving Home and Community Management of Malaria: Providing di Evidence Base."
Olugbenga Mokuola win for im own work, "Multifaceted Efforts at Malaria Control in Research: Management of Malaria of Various Grades."
Di number five winner, Chukwuma Agubata, collect winner for di work wey im call, "Novel Lipid Microparticles for Effective Delivery of Artemether Antimalarial Drug using a Locally-Sourced Irvingia Fat from Nuts of Irvingia Gabonensis var Excelsa (Ogbono)".
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di five scientist go share di money.
Susu wey talk for press conference say, "We know say e no easy to dey do scientific research for developing country dem like Nigeria, where things no too easy and e fit be challenge.
"We dey hope say di award go help give dem mind say make dem continue to dey do dia work to find answer to di palava wey we dey face everyday."
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis year dem put eye for malaria but Susu talk say for 2018 dem go look power (electricity) things.










