Bobi Wine send back $8,000 to Uganda government

Wia dis foto come from, AFP
Bobi Wine don reject im own $8,000 'bribe' money wey Ugandan lawmakers get.
Uganda Afrobeats star wey don turn to politician Bobi Wine na di latest opposition person to return $8,000 - money wey dem give all 429 MPs so that dem go fit follow dia people talk to support di age-limit bill.
Di bill na wetin National Resistance Movement, wey bi ruling party for government, wan try use to take comot di presidential age limit, wey dey for 75.
Wine write for one Facebook post say im don order im bank to "return di money back to sender."
Wine share dis letter on top Twitter:
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Im say dem dey spend money on top "matter wey no suppose to dey talk about at all at all."
Im also talk say e dey "unfortunate" say dem dey give di money to lawmakers when e be say "state lawyers, court workers, doctors, teachers and other public officers dey on strike or dem dey ready to strike over work condition wey no dey good".
We report on Wednesday say eight opposition MPs sef return dia own money.
End of Di one wey oda users dey read well well











