Ghana dey investigate gas explosion wey kill 7

Wia dis foto come from, Getty Images
Authorities inside Ghana don begin investigate wetin cause di gas explosion wey kill at least 7 people and wound over hundred others on Saturday night.
E don make am 8 times inside three years wey di country don experience gas explosion.
Tori be say di whole thing happen around 19:30 GMT on 7 October, when one tanker wey bin dey deliver natural gas, catch fire for Atomic Junction area of Accra.
Now people dey ask wetin be di safety guidelines on top di fuel station bizness inside Ghana.

Wia dis foto come from, Getty Images
According to Deputy Director Public Affairs for Ghana National Fire Service Billy Anaglate, na indiscipline of people wey dey sell inside fuel station na im dey always cause dis kain palava.
So dis time, Ghana government promise to make tough rules wey go prevent dis kain palava inside di country, but dem never disclose wetin dey inside di rule dem wan carry come out.
Ghana President Akufo Addo go do meeting with members of im cabinet on Thursday to decide di type of rule wey dem go put on top dis matter.







