La Niña weather fit bring drought and flooding come Africa

Wia dis foto come from, Valerie Batselaere
Di La Niña weather dey normally affect countries wey dey for pacific areas like Australia, Indonesia and countries for Latin America.
But dis year, di weather for Southern African countries fit bring heavy rain wey pass wetin dem expect.
For East Africa, di countries there fit see very dry conditions pass normal.

Wia dis foto come from, Stevie Mann
Dis na di warning wey di World Meteorological Organisation (WMO) don carry come today.
Farmers for all over Africa fit see say di kain weather pattern wey La Niña go bring fit affect dia crops.
Although di WMO also talk say e fit no strong reach as dem dey fear because e don already happen last year so dis year own fit dey weak.






