Nigeria @ 57: Wetin people dey talk
As di oyibo man dey talk am, ''different strokes for different folks.''
BBC News Pidgin talk to some people for di streets of Lagos and dem get different mind about how far Nigeria don come.
57 years after independence, Nigeria no be small pickin again. One thing dem all gree on top be say, im must tie im wrapper well so that things go better for di country.
