North Korea dey warn Nigeria on top Twitter?

Wia dis foto come from, Korean Central Agency/AFP
Na true say Kim Jong-Un don comot eye from di United States, South Korea or Japan sef, come face Nigeria as Im latest enemy?
Well, although one Twitter account wey di name na DPRK News Service tweet one warning like that give Nigerians, the truth be say na lie.
DPRK na short way dem dey pronounce North Korea and e mean 'Democratic People's Republic of Korea.'
Meanwhile, di fake tweet warn say Nigerians fit pay "heavy price" if dem continue to dey rude to North Korea leader, Kim Jong-Un.

Wia dis foto come from, DPRK News Service/Twitter
As dem see di tweet, na so some Nigerians don begin to beg say make North Korea no vex.

Wia dis foto come from, Ibee Sal/Twitter
One person no fear at all.

Wia dis foto come from, The Common Man/Twitter
Others no gree hear word.

Wia dis foto come from, Daddy D.O/Twitter
Wetin be dis DPRK News Service?
E don tey wey dis Twitter account, DPRK News Service don dey deceive people. Upon say di account no get di Twitter verification badge, e still get reach 243,000 followers.
End of Di one wey oda users dey read well well
No be North Korea am. Di country no even get any account on top social media.
Some tori people don see say dis account na play-play account, di one wey dem dey call "parody account".

Wia dis foto come from, DPRK News Service/Twitter
But many tori people and companies don fall mugu for dis account before.
When DPRK News Service abuse Americans on top social media when dem call Americans "imbecile", New York Times report am for dia website but di issue be say, North Korea government no talk dat kain thing at all.
Inside one interview with The Daily Beast, di person wey dey behind di account Derrick (no be im real name), talk say im no understand why some news agency still dey take am serious.











