BBC don launch Pidgin

BBC don launch brand new Pidgin service for Lagos Nigeria.

Editorial lead for Nigeria, Bilkisu Labaran, talk say im dey happy because the new language service go dey for young people wey dey always dey online.

Pidgin Service na one of the new services wey BBC don introduce among other ones wey dem dey plan like Afaan Oromo, Amharic, Gujarati, Igbo, Korean, Marathi, Punjabi, Telugu, Tigrinya, and Yoruba.