BBC don launch Pidgin service

BBC don launch Pidgin Service

E don tay wey we don dey hear di gist. E dey happen? E no go happen? If e happen, how e go be? Well, e don happen today.

BBC don launch new one wey be BBC News Pidgin Service.

BBC Pidgin na new Service

Di service go dey for Lagos but di plan na to serve people wey dey speak Pidgin for Central and Western Africa.

BBC don launch Pidgin Service

BBC Pidgin na part of di £289m plan wey BBC arrange to expand to many languages like Afaan Oromo, Amharic, Gujarati, Igbo, Korean, Marathi, Punjabi, Telugu, Tigrinya and Yoruba.

Pidgin na the language wey launch first.

BBC editorial lead Bilkisu Labaran

Bilkisu Labaran, wey be the editorial lead for BBC in Nigeria, talk say BBC Pidgin go siddon mainly for inside internet as tori go flow for inside website, Facebook and for Instagram.

Wetin we call dis Video, BBC don launch Pidgin

How Pidgin dey important?

BBC Pidgin na new Service

For Nigeria alone, 75 million people dey speak Pidgin and even more people dey follow yarn the language for other countries like Ghana, Cameroun, Guinea, Sierra Leone and Liberia.

BBC Pidgin na for young people

Labaran also talk say, as Africa be the youngest continent for the world as per na dem get youngest people pass, e good as BBC Pidgin dey internet because, young people go fit relate well-well.