Fifa World cup fixtures: Neymar, Messi, Ronaldo, Rashford and Qatar 2022 Fifa World Cup round of 16 qualification

How Morocco react to dia qualification

Wia dis foto come from, Getty Images

Di Qatar 2022 Fifa World Cup don dey reach wia di tension go high pass as e be.

Dis na as kontris don qualify for di next round of di competition, di round of 16 - dat na di knock out phase of di tournament.

Di group stage matches officially end on Friday wit plenty twists and turns. Table dey change as teams dey play dia final games.

One of di biggest surprises for di group stage na Japan wey come from back come top dia Group ahead of Spain and Germany.

South Korea and Portugal qualify for di round of 16 for di ongoing Fifa World Cup.

Na goals difference na im determine who comot and who qualify for Group G.

Ghana wey lose 0-2 to Uruguay and Uruguay wey win di match don cari dia bags dey go house.

Cameroon defeat Brazil but still crash out from di World Cup afta an entertaining encounter for Lusail Stadium.

Vincent Aboubakar head di winner in for stoppage time but im joy immediately turn to disappointment as dem give am s second yellow card for taking im shirt off.

Kontris wey don qualify

No forget say na 32 kontris dey play di competition out of which 16 go qualify for di next round.

Di kontris wey don qualify na;

Netherlands, Senegal, England, USA, Argentina, Poland, France, Australia, Japan, Spain, Morocco, Croatia, Brazil, Switzerland, Portugal and South Korea.

Netherlands top Group A

Wia dis foto come from, BBC Sport

England top Group B

Wia dis foto come from, BBC Sport

'Germany exit as fallen giant of world football'

Wia dis foto come from, BBC Sport

Belgium score only one goal for Qatar World cup

Wia dis foto come from, BBC Sport

Qatar Fifa 2022 Round of 16

Di Netherlands top Group A while Africa Cup of Nations winner Senegal come second.

Host kontri Qatar no do well at all for di tournament. Dem lose all dia three matches including di last game.

Surprisingly Ecuador wey start di competition well afta di 2-0 for dia first game disappoint plenty of dia fans.

Di Three Lions, England top Group B afta beating dia neighbors Wales 3-0 courtesy of two goals from Manchester United forward Marcos Rashford and Phil Foden.

Still for Group B, USA carry second behind England.

While the Netherlands go play USA for di round of 16, England go play Senegal - wey fit be dia toughest match of di tournament.

Argentina complete di turnaround from di shock opening World Cup loss to Saudi Arabia by qualifying for di last 16 in impressive style against Poland.

Poland join dem for di group ahead of Mexico on goal difference.

On Wednesday Australia join France to reach di knockout stage of the World Cup for di first time in 16 years afta dem shock Denmark.

Japan score controversial winner as dem stage anoda extraordinary World Cup comeback to top Group E ahead of Spain and reach di last 16.

Ao Tanaka claim Japan second goal afta di Video Assistant Referee rule say di ball no go out of play before Kaoru Mitoma cross from di byeline.

Morocco beat Canada to top Group F and reach di World Cup knockout stage for di first time in 36 years.

Di Atlas Lions, wey previous trip to di last 16 come for 1986, dem finish above 2018 finalists Croatia, while Belgium - wey rank second for di world - finish third for di group.

How Fifa decide who qualify?

If teams remain level on di same points afta three games, na goal difference dem go take decide who qualify.

Di condition for di full tie-breaker na:

  • Points gathered
  • Goal difference
  • Goals scored
  • Head-to-head results
  • Fair play: di team wey get highest number of indiscipline points go win (one yellow card equals one point, one red card wey pesin collect for two yellows equals three points, a direct red card equals four points and a direct red card for a player wey already get yellow equals five points)
  • Team wey dem draw last

Confirmed last-16 fixtures and Kick-off time (GMT)

England dey face Senegal for di next round

Wia dis foto come from, BBC Sport

Saturday December 3

  • Netherlands vs USA - Kick-off 3pm
  • Argentina vs Australia - Kick-off pm.

Sunday December 4

  • France vs Poland - Kick-off 3pm
  • England vs Senegal - Kick-off 7pm

Monday December 5

  • Japan vs Croatia - Kick-off 3pm
  • Brazil vs South Korea - Kick-off 7pm

Tuesday December 6

  • Morocco vs Spain - Kick-off 3pm
  • Portugal vs - Kick-off 7pm