Chelsea vs Man United highlights: Casemiro score equaliser for di Red Devils afta Jorginho penalty

Wia dis foto come from, Getty Images
Chelsea and Manchester United play draw wen dem meet for Stamford Bridge on Saturday.
Na ogbonge match for di two sides.
Jorginho goal for di 85th minute bin first give di Blues di lead.
But Casemiro header, inside di extra time of di match deny Chelsea of dat crucial win for Stamford Bridge.
Live updates of di match as e happun
FIRST HALF
Chelsea 0 - 0 Man Utd
Game don start!
1 min: Di players don dey di pitch.
End of Di one wey oda users dey read well well
5 mins: Antony try to carri di ball pass Ben Chilwell but e no work.
7 mins: : Casemiro pass give Sancho, wey try to pass give Shaw. But dem block am.
9 mins: Eriksen pass give Shaw from midfield. E fire shot form 22 yards. E go wide.
11 mins: : Azpilicueta go down afta im and Sancho nack head but e dey fine. Notin do am.
13 mins: Close for United as Fernandes pass give Antony from 22 yards, e play am go di bottom corner. Kepa save am.
17 mins: United get di ball inside di box but dem no fit convert am and Shaw dey flagged for offside.
22 mins: Antony win free kick from 25 yards from goal.
Dem take di free-kick but e no enta.
25 mins: Manchester United get anoda corner afta Kepa no fit hold one ball.
27 mins: Manchester United try as Bruno Fernandes pass give Marcus Rashford but Kepa save am.
30 mins: One poor kick from Kepa pass di ball straight to Luke Shaw.
32 mins: YELLOW CARD!
Dem book Antony for fouling Jorginho just before Kepa push Marcus Rashford shot comot.
36 mins: SUBSTITUTION!
Chelsea change - Marc Cucurella comot for Mateo Kovacic.
38 mins: Close!
Chelsea take one free kick - Mateo Kovacic find Raheem Sterling but im pass deflect to Pierre-Emerick Aubameyang on di edge of di area but im shot go wide.
44 mins: Bruno Fernandes pass di ball and Antony shoot am but e go wide.
HALF-TIME
Chelsea 0-0 Man Utd
No goals in di first half but Manchester United get upper hand.
SECOND HALF
46 mins: Game don start!
Chelsea 0-0 Man Utd
50 mins: Ruben Loftus-Cheek shot dey deflected and e go back for di first corner of di game. Mason Mount play am but nobody reach am.
51 mins: SUBSTITUTION
Fred come in for Jadon Sancho
54 mins: Raphael Varane fall as e dey try to clear ball from Pierre-Emerick Aubameyang. E stand up but e no look like say evrytin dey alright wit am.
59 mins: SUBSTITUTION
Raphael Varane dey able to waka comot di pitch but e dey vex as e even hit one of di corner flag as e dey waka comot.
Victor Lindelof dey replace am.
62 mins: Mateo Kovacic no fit hold down di ball afta Kepa long kick. and pipo hala.
65 mins: Luke Shaw head Ruben Loftus-Cheek ball to give Chelsea corner but Ben Chilwell ball no enta.
67 mins: Trevoh Chalobah block one fine ball from finding Marcus Rashford.
Mason Mount try to turn Luke Shaw just inside di box but e no work.
70 mins: Raheem Sterling carri di ball enta di box from di left and fall down, Chelsea fans cry for penalty. But Referee Stuart Attwell say play on.
72 mins: Corner for Chelsea - Trevoh Chalobah reach di ball and head am onto di bar!
74 mins: SUBSTITUTION
Christian Pulisic come on for Pierre-Emerick Aubameyang.
76 mins: Bruno Fernandes fire from a distance but Kepa push am out and Manchester United get corner. Christian Eriksen delivery dey poor and e no fit pass di first man.
78 mins: SUBSTITUTION
Carney Chukwuemeka and Armando Broja come on for Ruben Loftus-Cheek and Raheem Sterling.
79 mins: SUBSTITUTION
Manchester United replace Christian Eriksen wit Scott McTominay while Marcus Rashford comot for Anthony Elanga.
83 mins: PENALTY TO CHELSEA!
Stuart Attwell point to di spot as Armando Broja go down inside di box under pressure from Scott McTominay.
85 mins: Goal!
Chelsea 1-0 Man Utd
Jorginho keep im cool as e take di spot kick wey send David de Gea di wrong way and Stamford Bridge burst out with shouts.

Wia dis foto come from, Getty Images
89 mins: YELLOW CARD
Luke Shaw colect afta e clip Cesar Azpilicueta.
90 mins: Di board go up to show 6 additional minutes.
90 + 2 mins: YELLOW CARD
Jorginho collect as e stop Anthony Elanga. Manchester United dey try to find di equaliser.
90+4mins: Anthony Elanga pass one dangerous ball, Manchester United don increase pressure.
90 +4 mins GOAL!
Chelsea 1-1 Man Utd
Casemiro score.
Kepa try to stop Casemiro header but di ball just cross di line as e bounce down and Manchester United equalise. WOW!
Na im first goal for di club!

Wia dis foto come from, Getty Images
FULL- TIME
Chelsea 1-1 Man Utd
Chelsea almost win but Casemiro no gree for dem as e score di equaliser just some minutes before final whistle!
Team news - How Chelsea and Man Utd bin line-up to start
Chelsea boss Graham Potter don make four changes afta di goalless draw against Brentford during di week.
Thiago Silva, Ben Chilwell, Raheem Sterling and Pierre-Emerick Aubameyang all go start, with Kai Havertz, Armando Broja and Conor Gallagher wey dey bench. Kalidou Koulibaly no dey di squad.
Chelsea XI: Arrizabalaga, Azpilicueta, Silva, Cucurella, Chilwell, Chalobah, Loftus-Cheek, Jorginho, Mount, Sterling, Aubameyang

Despite say e score for di 2-0 win over Spurs on Wednesday, Fred dey bench for di only change for Manchester United, with Christian Eriksen wey dey start instead of am.
Man Utd XI: De Gea, Dalot, Varane, Martinez, Shaw, Casemiro, Eriksen, Antony, Fernandes, Sancho, Rashford.











