Dinamo Zagreb vs Chelsea Highlight: Aubameyang fail to shine as Chelsea lose first match for champions league

Wia dis foto come from, Getty Images
Two-time winners Chelsea start dia Champions League campaign wit shock defeat for Dinamo Zagreb.
Di Croatian champions get bad record for dis competition - winning just five of 43 games before dis meeting - but dem stubbornly hold on afta taking di lead for first-half.
Di dangerous Mislav Orsic net di 13th-minute winner, running through from di halfway line and beautifully score agaisnt Kepa Arrizabalaga.
Dinamo almost score di second but Arrizabalaga tip Stefan Ristovski shot wey hit bar.
Deadline-day signing Pierre-Emerick Aubameyang get im Chelsea debut and, although di ex-Arsenal skipper get one goal wey referee overrule for offside, at di end e no play well for di game.
Armando Broja replace Aubameyang just before di hour mark, but di Albanian make small impact for overall homas Tuchel team wey no perfom well.
Serie A champions AC Milan dey go RB Salzburg for di oda game for Group E.
HALF-TIME
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
Second Half: KICK-OFF
FULL TIME: E don finish
Dinamo Zagreb 1-0 Chelsea
90+8 mins: SUBSTITUTION
Bruno Petkovic, wey set up di goal, comot for Josip Drmic.
90+7 mins: Hakim Ziyech takes DI... and e hit di wall again.
90+6 mins: YELLOW CARD
Martin Baturina chop card afta foul on Reece James.
90 mins: INJURY TIME
Eight minutes added time. Chelsea get hope so?
88 mins: And dat fit just be dia second and third best chance of di game.
Dominik Livakovic pull off a good double save to deny Mason Mount and Hakim Ziyech.
84 mins: Marc Cucurella stand for back of Luka Ivanusec heel just as di Dinamo man wan run comot.
82 mins: Great block by Robert Ljubicic to stop Kai Haverz header from only six yards out.
81 mins: YELLOW CARD for Chelsea manager Thomas Tuchel.
80 mins: Dinamo Zagreb 1-0 Chelsea
Be like say Chelsea don go back to dia back three/five now.
79 mins: Kai Havertz cross and Hakim Ziyech volley di ball into di turf and e bounce over di bar.
77 mins: Di player wit di most chances created for Chelsea for dis match so far na defender Wesley Fofana.
75 mins: SUBSTITUTION
Chelsea bring on Christian Pulisic for Raheem Sterling.
Dinamo bring in Rasmus Lauritsen and Dario Spikic for Sadegh Moharrami and goalscorer Mislav Orsic.
Kalidou Koulibaly chop yellow card for stopping Dinamo break.
73 mins: You know wen team no quite look right? Dat na Chelsea for you.
71 mins: SUBSTITUTION
Dinamo Zagreb 1-0 Chelsea
Chelsea bring on dia £60m Marc Cucurella for £45m Ben Chilwell at left-back.
67 mins: YELLOW CARD
Chelsea defender Kalidou Koulibaly chop card for tackle on Mislav Orsic for di halfway line as Dinamo threaten anoda dangerous break.
65 mins: Home fans boo as Chelsea Mason Mount catch Stefan Ristovski for face. Di referee give Zagreb free-kick and den change im mind.
63 mins: Reece James cross and Armando Broja no fit jump high enough to head am in.
63 mins: di ball break for Hakim Ziyech for di box but e lift di ball over everi body head for di centre.
60 mins: SUBSTITUTION
Pierre-Emerick Aubameyang no dey impressive tonight and Tuchel replace am wit Armando Broja for im Champions League debut.
Jorginho replace ex-Dinamo man, Mateo Kovacic.
59 mins: YELLOW CARD
Chelsea want penalty as Josip Sutalo push Kai Havertz for back. But no be enough contact and di referee says no.
55 mins: BALL HIT BAR
Dinamo Zagreb don try reduce di pressure from Chelsea. Dem relaunch attack and almost score.
Stefan Ristovski hammer di shot from almost 30 yards out wey Kepa tip onto di post.
51 mins: Chelsea don begin threaten more since second half start.
49 mins: DISALLOWED GOAL
Referee deny Pierre-Emerick Aubameyang im debut goal sake of offside.
47 mins: Hakim Ziyech double Chelsea shot on target total within two minutes of coming on. Keeper save di Moroccan 20-yard effort.
SUBSTITUTION: Attacking change for Chelsea at half-time. Hakim Ziyech replace Cesar Azpilicueta. Back four?
46 mins: Dinamo Zagreb 1-0 Chelsea. Second half don start
Dinamo Zagreb 1-0 Chelsea
Chelsea disappoint well-well for dat first half. Mislav Orsic na di problem of London again.
First Half
45 mins: Good block by Ben Chillwell to deny Mislav Orsic a second goal. And luckily for Chelsea Luka Ivanusec kick di ball go up.
43 mins: Chelsea striker Pierre-Emerick Aubameyang go for header but e no make proper contact.
41 mins: After a good spell of attacking, now Dinamo dey defend well wit plenty players. Chelsea no fit tear enta di wall of di defence
38 mins: Dinamo dey do more of di attack dan Chelsea right now.
36 mins: Chelsea neva get dat balance yet. Dem need to dey quicker in di way dem dey move di ball.
34 mins: Mateo Kovacic win di ball off Mislav Orsic... and den pass am to a Dinamo player.
31 mins: Still Dinamo Zagreb 1-0 Chelsea
Dinamo dey very efficient. Dem dey play like say dem o scroe each time dem attack Chelsea.
Kepa parry Arijan Ademi's volley from outside di box.
30 mins: Dinamo get free-kick now. A chance to increase Chelsea pain? Almost...
Di free-kick bounce round di box and dat man Mislav Orsic curls just wide of di top corner
26 mins: Since di beginning of 2020-21, na only Karim Benzema don score as many goals for European competition versus English opposition as Mislav Orsic.
25 mins: Good defending by two Dinamo players to stop Raheem Sterling run into di box wey carry ball go goal-kick
Dinamo Zagreb 1-0 Chelsea
24 mins: Mason Mount just overhit a through ball to Pierre-Emerick Aubameyang, wey fall as im hit im heel
19 mins: Dinamo Zagreb lost three of dia last five Champions League matches wia dem score di opening goal.
One of doz na 7-1 loss at home to Lyon on 7 December 2011... afta 17-year-old Mateo Kovacic - for Chelsea midfield today - put demem ahead.
18 mins: Mislav Orsic name sound familiar. E score hat-trick against Tottenham to knock dem out of di 2020-21 Europa League.
E score against West Ham last season too.
14 mins: Dinamo Zagreb attack for the first time... and score
13 mins: GOAL! Dinamo Zagreb 1-0 Chelsea. Mislav Orsic score for di home team.

Wia dis foto come from, Getty Images
5 mins: Unselfish from Pierre-Emerick Aubameyang. Raheem Sterling play in di Chelsea debutant.
2 mins: Chelsea in dia white away kit dey see a lot of di ball early.
Dinamo Zagreb 0-0 Chelsea
Dinamo Zagreb vs Chelsea Line up
Dinamo Zagreb: Livakovic, Ristovski, Sutalo, Peric, Misic, Moharrami, Ivanusec, Ademi, Ljubicic, Petkovic, Orsic.
Chelsea: Arrizabalaga, Azpilicueta, Fofana, Koulibaly, James, Mount, Kovacic, Chilwell, Havertz, Aubameyang, Sterling
Dey refresh dis page for updates










