Cameroon vs Nigeria Wafcon 2022 highlight: Ajibade goal make Super Falcons win

Wia dis foto come from, Twitter/@Cafwomen
Cameroon and Nigeria Wafcon 2022 quarter final match end in favour of di Super Falcons.
Rasheedat Ajibade stunning header for di 58th minute make Nigeria defeat Indomitable Lionesses of Cameroon 1 - 0.
Thursday result mean say di Nigeria female national football team don advance to di Semi-finals to jam di host, Morocco.
Super Falcons win also give dem automatic qualification for di New Zealand/Australia 2023 Fifa Women's World Cup.
Nigeria vs Morocco semi final match go happun for Rabat on Monday 18 July, 2022.
South Africa also pick di last automatic World Cup ticket afta dem beat Tunisia by one goal for di oda Thursday game.
Super Falcons coach react to victory
Super Falcons Coach Randy Waldrum say im team fit celebrate small afta dem pick di World Cup ticket.
"We dey go World Cup, we check off one box because na one of our goals and now wey we don qualify.
End of Di one wey oda users dey read well well
"We dey celebrate a little in a smart way today, and den we go prepare for di next goal wey be to win di tournament".
"Our focus na to beat Cameroon today and henceforth, our team go put di focus on Morocco.
Cameroon vs Nigeria match highlight
2nd half match report
90' Two minutes of extra time.
89' Nigeria dey feel di pressure now late on inside di match.
88' Cameroon dey send plenty players forward and now dem get corner.
86′ Cameroon substitution Abam - comot, Kameni- enta.
85' Nigeria don switch to defence mode now wit few minutes remaining.
83' Cameroon pressure dem force Nigeria defence to make mistake.
80' Cameroon send in a dangerous ball, Nigerian goalkeeper save di ball but Cameroon player jam her as she save di ball wey make her roll for ground injured.
75′ Cameroon push to attack Nigeria but still no way for dem yet.
72' Double substitution for Nigeria Ordega comot- Kanu- enta, Okobi- comot Chikelu- enta.
68′ Cameroon substitution Fatima - enta, Mbeleck - comot.
68′ Ayinde high boot catche Abam.
62′ Third yellow for Cameroon na Onguene collect di card.
Goal' Ajibade header beat di Cameroon goalkeeper
Okobi run worry di Cameroon defense before Onumonu cross find Ajibade wey head di ball inside di net.
53' Di space between Nigeria attack and midfielder too much e
49' Nigeria get more possession for di opening minute but still lack di creativity to break di Cameroon defence.
Half Time score 0-0
1st Half match report
40' Nigeria dey pepper di Cameroon defence, wit shots from Ordega and Ucheibe.
Di winner of dis match go play di host nation Morocco.
33′ Nigeria with another corner kick but dis time no fit trouble di keeper.
28′ So far di two teams dey struggle to create clear chances.
24′ Nigeria come close!
But Mbonu wey bin dey for Cameroon goal do well to block Plumptre header.
21′ Super Falcons win another free kick
Okobi step up again to deliver but e no reach any Nigerian player.
12' Di score na 0-0 between Nigeria and Cameroon.
Some big names from di two kontries dey di stadium to watch di match.
Cameroon Legend and football president Samuel Eto and Nigeria football federation President Amaju Pinnick dey inside di stadium dey watch di match.
Dis match na repeat of di 2016 final for Yaounde, di derby dey expected to produce fireworks.
Already Zambia and Morocco don qualify for di semi-final round of di competition.
On Tuesday Zambia beat Senegal on penalties to progress while Morocco beat Botswana 2-1.
Super Falcons team line-up
16 Chiamaka Nnadozie
7 Toni Payne
5 Onome Ebi
3 Osinachi Ohale
4 Ashleigh Plumptre
18 Halimatu Ayinde
9 Ifeoma Onumonu
13 Ngozi Okobi
23 Christy Ucheibe
17 Francisca Ordega
15 Rasheedat Ajibade
Lioness team line-up
16 Ange Bawou
12 Claudine Meffometou
6 Estelle Johnson
11 Marie-Aurelle Awona
15 Colette Nzdana
18 Claudia Voulania
7 Gabrielle Onguene
17 Brigitte Omboudou
20 Genevieve Ngo Mbeleck
22 Michaela Abam
3 Ajara Nchout










