Man City vs Liverpool highlight: Premier League top two draw for Etihad Stadium

Wia dis foto come from, Getty Images
Sadio Mane early second half goal help Liverpool collect one point for dia top of di table clash against Manchester City as dem draw 2-2 for Etihad.
Di Merseyside club twice come from behind to peg back City wey bin look like say dem go carry di day.
First half goals from Kevin De Bruyne and Gabriel Jesus and one from Diogo Jota for Liverpool bin put City for di driving seat for dis crucial match.
But Senegalese forward, Mane, equalise seconds afta di second half start.
Di match really show say dis two deserve to dey wia dem dey today as both teams show dia strength.
In di end nothing fit separate dis two for dis match as dem share one point each.
Di result mean say Manchester City retain dia slender one-point advantage for di top of di Premier League.
How di match go
Second half
Liverpool coach Jurgen Klopp don come out to di dugout as players don enta pitch too.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di German and im team neva dey behind for any Premier League for half time dis season, make we see how dem go respond.
46 mins - Man City don restart play.
And straight from di restart Liverpool equalise through Sadio Mane.

Wia dis foto come from, EPA
Salah play good through ball to di Senegalese wey fire im shot past Ederson for City goalpost.
52 mins - Liverpool really dey gingered for dis second half. City need Ederson to save Diogo Jota shot so dem no go fall behind for di first time for dis match.
57 mins - Di referee don caution Thiago afta im foul Gabriel Jesus. Di Spanish midfielder escape from receiving any booking.
60 mins - Gabriel Jesus find imsef for better position inside di Liverpool penalty area. Im beat Alisson but Van Dijk block im shot make e for no enta net.
Yellow card for Thiago. Dis time di player no avoid di card from di ref.
63 mins - Raheem Sterling don give City di lead for di thrid time but VAR dey check am. Di goal no go stand.
Di former Liverpool player don run enta offside wen im receive di through pass.
68 mins - City break quickly again as De Bruyne play in Sterling. Di Englishman try to dribble Van Dijk but di defender stand im ground.
70 mins - Substitution Diaz ON, Jota OFF.
71 mins - Salah go close to scoring for Liverpool. Di Egyptian try to bend im shot go di bottom corner but e take deflection. VAR bin check im di ball hit City player for hand nut later rule say na im leg di shot hit.
72 mins - Now na City turn to go close as Gabriel Jesus shot hit di side net. Im teammates no dey happy as dem bin expect am to cut di ball back for dem.
75 mins - City make dia first substitution. Riyad Mahrez don replace Raheem Sterling.
78 mins - Substitution Naby Keita don come on for Jordan Henderson.
82 mins - Fabinho foul Silva. E look dangerous, referee Anthony Taylor show di midfielder Yellow card.
84 mins - Man City make anoda substitution. Jack Grealish don enta for goalscorer Gabriel Jesus. Liverpool respond wit change of dia own. Firmino come on for Sadio Mane.
86 mins - Liverpool midfielders need to dey careful now as two of dem dey on yellow card. Thiago escape second yellow afta im foul De Bryune.
89 mins - Liverpool defender Van Dijk don see Yellow card for foul wey im commit. Di Dutch defender bring down di Belgian wey bin dey charge towards goal.
Hit di post! From di freekick, Riyad Mahrez shot hit di outside of di post. Close.
90+1 mins - Referee Anthony Taylor don add four extra minutes.
90+4 mins - Mahrez wit good chance to win di game for City! Di Algerian attempt to chip Alisson no dey successful as im shot go over di bar.
Full time - Manchester City 2-2 Liverpool
First half

Wia dis foto come from, Getty Images
1 min - Liverpool captain Jordan Henderson don take di first kick of di game as dis big match don start.
5 mins - Raheem Sterling! Good save by Alisson wey stop di Englishman save.
6 mins - Goal! Kevin De Bruyne don give City di lead.
City take up quick freekick wey see Kevin de Bruyne shot take deflection off Joel Matip before e go in.
12 mins - Jota goal! Liverpool quickly respond. 1-1.
Liverpool hit back six minutes afta City take di lead. City head one attack away but Andy Robertson send deep cross back inside Liverpool eighteen. Im put on a plate for Diogo Jota to score.

Wia dis foto come from, Getty Images
16 mins - Diogo Jota now be di second Portuguese player to score 40 Premier League goals, after Cristiano Ronaldo (96). Jota don score 15 of dis season.
19 mins - Di gam don calm down small afta dat fast start.
28 mins - Yellow card for Andy Robertson. Na im be di first player to collect card for dis game.
29 mins - De Bruyne almost give City di lead again but im shot go wide.
34 mins - City create anoda chance again through Joao Cancelo. Di left back cut inside and shoot but di shot take small deflection go out for corner. Liverpool clear di cross from di corner.
37 mins - Gabriel Jesus! Di Brazilian don give City di lead as im run onto Cancelo cross to shoot di ball past Alisson.
Manchester 2-1 Liverpool.
40 mins - Liverpool look like say dem no expect dat goal to stand as di defence bin tink say Jesus dey offside.
Bernado Silva don collect Yellow card.
45 mins - Laporte wit good chance to increase City lead. Im connect wit cross wey Alisson save well but di flag later go up for offside.
Half time - Man City 2-1 Liverpool.
Man City vs Liverpool Lineup
Man City: Ederson, Walker, Stones, Laporte, Joao Cancelo, Bernardo Silva, Rodri, De Bruyne, Foden, Gabriel Jesus, Sterling.
Subs: Ake, Gundogan, Grealish, Zinchenko, Steffen, Fernandinho, Mahrez, McAtee, Lavia.
Liverpool: Alisson, Alexander-Arnold, Matip, van Dijk, Robertson, Henderson, Fabinho, Thiago, Salah, Jota, Mane.
Subs: Konate, Milner, Keita, Firmino, Gomez, Jones, Tsimikas, Diaz, Kelleher.












