Gabon 1 - 1 Ghana Afcon 2021: Thomas Partey through pass make André Ayew score, game end for draw

Wia dis foto come from, Getty Images
A last minute goal make Ghana lose three points for dia match Gabon.
Jim Allevinah 88 minutes goal help Gabon equalise for di last minute of di game - na Guélor Kanga give am di pass.
Di black stars bin dey lead wit Andrew Ayew first half goal. Dem continue to press for second half but Gabon show a lot of promise.
Gabon continue to pree even without dia captain Pierre-Emerick Aubameyang wey no make di squad.
Dis na because di former Arsenal captain dey suffer some complication as e recover from Covid.
As di match end like dis Gabon dey occupy di second position for Group C wit four points.
Already, Morocco don become di first kontri to qualify go di second round of di tournament for Group C, afta dem beat Comoros earlier on Friday.
Goals from Selim Amallah and Zakaria Aboukhal help Morocco secure di 2-0 victory.
Di Black Stars bin lose dia first match 1-0 to Morocco - Ghana dey for third position wit just one point.
A win for Gabon go mean say Ghana chances for di tournament inside go dey slim as Gabon win dia first game against Comoros.
Second Half

Wia dis foto come from, Getty Images
Game don start and na still Gabon 0, Ghana 1.
46mins: Alexander Djiku concede corner for Gabon.
46mins: Junior Assoumou miss goal attempt afta e use head from centre of di box sake of di corner.
48mins: Dénis Bouanga win free kick for di defensive half.
48mins: Offside by Johann Obiang of Gabon.
50mins: Aaron Salem Boupendza win free kick for di defensive half.
51mins: Foul by Kamaldeen Sulemana of Ghana make Louis Ameka win free kick for di defensive half.
53mins: Substitution for Gabon. Jim Allevinah replace Dénis Bouanga.
54mins: Junior Assoumou conceded corner.
56mins: Ghana defender block shot from Johann Obiang from di left side of di box.
57mins: Anthony Oyono chop yellow card for bad foul on Kamaldeen Sulemana.
59mins: Daniel-Kofi Kyereh chop yellow card for bad foul on Guélor Kanga.
61mins: Substitution for Ghana. Edmund Addo replace Kamaldeen Sulemana.
62mins: Gabon win corner wey Abdul Rahman Baba. concede.
64mins: Guélor Kanga miss attempt afta e use right leg shoot from more dan 35 yards.
65mins: Substitution for Ghana. Joseph Paintsil replace Iddrisu Baba sake of injury.
67mins: Thomas Partey win free kick for di defensive half.
67mins: Substitution for Gabon. Ulrick Eneme-Ella replace Serge-Junior Martinsson-Ngouali.
70mins:Foul by Aaron Salem Boupendza
71mins: Keeper save attempt by Guélor Kanga wey play shot from more dan 35 yards.
73mins: Edmund Addo win free kick for di defensive half.
75mins: Gabon defender black Joseph Paintsil shot from outside di box blocked.
76mins: Substitution for Gabon. Alex Moucketou-Moussounda replace Louis Ameka.
79mins: André Ayew win free kick for di attacking half.
80mins: Jordan Ayew shoot off target from a direct free kick.
81mins: Joseph Wollacott chop yellow card.
83mins: Thomas Partey win free kick for di defensive half.
86mins: Foul by André Biyogo Poko
88mins: Goal! Gabon 1, Ghana 1. Na Jim Allevinah score for Gabon.
90mins: Joseph Paintsil win free kick.
90mins+2: Thomas Partey header from di centre of di box from corner.
Second Half don end, Gabon 1, Ghana 1.
Dey refresh di page for Live updates of di match
First Half

Wia dis foto come from, Getty Images
1min: Na Ghana kick di first ball
5mins: Guélor Kanga take free kick from di left and cross inside di box.
10mins: Plenty activity dey happen for di midfield. Di two team no fit go front.
14mins: André Ayew go di right side of di box and cross enta di oda side. Amonome deflect di ball away from di goal.
19mins: Goal! Andre Ayew score wit long range shot from outside box 18
20mins: Bouanga take corner kick too hard, and di ball go over di line. Goal kick for Ghana.
24mins: Autchanga receive pass on di left, drives di ball up go middle Yiadom block di shot.
25mins: Yellow card for Manga, Gabon centre-back as e kick André Ayew.
28mins: André Ayew win free kick for di defensive half.
29mins: Guélor Kanga pass give Obiang on di left side of di box but Amartey head am comot.
32mins: Jordan Ayew wins free kick for di defensive half.
34mins: Alexander Djiku win free kick for di defensive half.
36mins: Thomas Partey chop yellow card for bad foul.
38mins: Gabon goal keeper save André Ayew right.
39mins: Hand ball by André Ayew.
42mins: Guélor Kanga miss goal afta e use right leg hit shot from more dan 35 yards.
43mins: Gabon keeper save Dénis Bouanga shot from long range.
45mins: Dénis Bouanga of Gabon win free kick for di defensive half.
First Half don finish and na Gabon 0, Ghana 1.
Senegal vs Guinea

Wia dis foto come from, Getty Images
Senegal vs Guinea
Senegal and Guinea don retain dia first and second position for group B for di ongoing African cup of Nations (Afcon) 2021 for Cameroon.
Saido Mane and Naby Keita wey dey both play for Liverpool no shine for di match.
Di two kontris dey four points each afta dia match end nil-nil dis afternoon.
Senegal and Guinea move closer to reach di last 16 for di Africa Cup of Nations sake if di draw.






