Nigeria vs Cape Verde live stream: Super Eagles World Cup qualifier preview, how to watch

Wia dis foto come from, FIFA
Nigeria vs Cape Verde game kickoff by 5pm on Tuesday for Lagos.
Nigeria gatz win or draw at home wen dem jam Cape Verde on 16 November, 2021 if dem go qualify for 2022 World Cup Qualifier playoffs in March.
Di Super Eagles currently get 12 points at di top of Group C standings wit five matches played so far.
While Cape Verde wey defeat Central African Republic 2 - 1 on Saturday dey at 10 points.
So both di Tubarões Azuis [Blue Sharks] and di Super Eagles go dey aim for a win.
As far as Group C dey concern, e dey right to say Nigeria vs Cape Verde qualifier match na winner takes it all.
Super Eagles line up

Wia dis foto come from, Super Eagles
Nigeria lineup: 1. Okoye, 20. Awaziem, 5. Troost-Ekong, 6. Balogun, 3. Collins, 4. Ndidi, 10. Aribo, 15. Simon, 18. Iwobi, 9. Osimhen, 19. Ighalo.
Cape Verde lineup: 1. Vozinha (G), 2. Stopira, 7. Andrade, 22. Fortes, 4. Fortes S, 3. Lopes, 20. Mendes (C), 10. Monteiro, 15. Moreira Fernandes, 18. Rocha Santo
End of Di one wey oda users dey read well well
Nigeria vs Cape Verd Live: How to watch di match
Venue: Teslim Balogun Stadium, Lagos
Kick-Off time: 5.00pm
Nigeria Football Federation dey expected to Live stream di match ontop dia web page between 5pm to 7pm on Tuesday as di Nigeria vs Cape Verde match dey happun.
Click here to watch di Nigeria vs Cape Verde live stream.
Also NFF say pipo fit watch dis match end to end via dia mobile app [TheNFF mobile app] on play store.

Wia dis foto come from, NFF
Nigeria vs Cape Verde prediction: Sunday Dare charge Super Eagles
Youth and Sports Development Minister Sunday Dare say;
"Winning away from home gatz boost Nigeria Super Eagles morale ahead of the all important clash against Cape Verde on Tuesday.
"Make we keep di focus. Make we finish di job in Lagos on Tuesday. We dey 100% behind una," Oga Dare charge Super Eagles.
With 12 points, two clear of dia closest rivals, Cape Verde, di Super Eagles go need just a point at home on Tuesday to book a place inside di final round of 2022 World Cup African qualifiers.











