Nigeria vs Central African Republic: Super Eagles record shock defeat for Teslim Balogun stadium

Wia dis foto come from, Getty Images
Central African Republic produce shock for Group C as dem beat Nigeria 1-0 for Teslim Balogun stadium for Lagos.
Karl Namganda score di only goal of di game for injury time afa dem soak up lots of pressure from di Super Eagles.
Di victory for Central African Republic end Nigeria unbeaten start to di qualification stage afta dem win dia first two group matches.
Afta three matches, Nigeria still dey top of di group wit six points while Cape Verde dey second wit four points.
Central African Republic get di same four points but dem don score fewer goals dan Cape Verde.
Liberia na dem dey bottom of di group wit one point.
Di two teams go meet again on Sunday for di second-leg. E go hold for Douala for Cameroon.
Den dey play di match away from home because Confederation of African football rule say no football field for Central African Republic dey fit and proper for international matches.
End of Di one wey oda users dey read well well
More dey come.














