Villarreal win Europa League for first time as dem beat Manchester United 11-10 in penalty shoot-out

Wia dis foto come from, Getty Images
Villareal beat Manchester United on penalties to lift di Europa League trophy for di first time for dia history.
Di Yellow Submarines beat Di Red Devils 11-10 on penalty shootout to win.
Man U keeper De Gea miss di decisive penalty for di game.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di win give Villarreal dia first major trophy in dia history and former Arsenal boss Unai Emery lift di Europa League for di fourth time.
Gerard Moreno bin score for 29 minutes inside di dramatic Europa League Final game to give Villareal di lead.
But Manchester United reply for di 55th minute to level di game up wen Edinson Cavani convert shot from Marcus Rashford to goal.
Afta dat, both clubs no score again till full time over and di game gatz to enta extra time.
Dis na di first Europa League final to go to extra time since 2014, wen Emery Sevilla beat Benfica on penalties.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Uefa Europa League final happun for Gdansk Poland on Wednesday evening.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Yellow Submarines wey bin never win major trophy for dia 88 years of age reach dia first ever major final after dem beat Arsenal while di Red Devils beat Roma to enta final.
Form guide
Villarreal
Form: LWWLDW
Last game: Real Madrid 2-1 Villarreal
League position: 7th for Liga
Manchester United
Form: WDLLWL
Last game: Wolves 1-2 Man. United
League position: 2nd for Premier League
See foto of Manchester United team as dem arrive for Gdańsk!
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Wetin pipo bin predict
For di final of di Europa League, BBC Pidgin tok wit Benjamin Okenna and Carl Orakwe two football sabi pipo wey drop dia predictions for di match.
Oga Okenna: "With three wins for four finals Manager Unai Emery fit go back to im defensive approach wey fit frustrate United."
Villarreal 1-0 Man Utd
"As soon as I see di caliber of teams wey make up di round of 16, I tell myself say surely Manchester United go win di Cup." Na wetin oga Orakwe tok.
E add say "Like am or not, you must give Ole Gunnar Solskjær some credit. After im poor start to di season, him don steady di ship and carry United this far."
Villarreal 1-2 Man Utd










