Rafael Leao: AC Milan and Portuguese forward score fastest goal for Serie A history

Wia dis foto come from, Getty Images
Rafael Leao score di fastest goal for Serie A history as AC Milan net just afta six seconds of dia game for Sassuolo on Sunday.
Di Portuguese forward, 21, collect Hakan Calhanoglu pass to put di league leaders ahead from di kick-off.
Leao goal beat di record of 8.9 seconds wey Piacenza Paolo Poggi set against Fiorentina on 2 December 2001.
Milan bin dey one point clear of city rivals Inter for di top as dem enta di game.
Belgium midfielder Alexis Saelemaekers add di second goal in di middle of di first half before Domenico Berardi score one back for dia sixth-placed Sassuolo.
But na Leao early strike na im go siddon ontop di book of record.
Di goal even quick pass di fastest strike for Premier League history - Shane Long goal for Southampton against Watford on 23 April 2019 afta 7.69 seconds.
Who be Rafael Leao?
Rafael Alexandre Conceição Leão na 21-year-old Portuguese professional footballer wey dey play for Italian club A.C. Milan as forward.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem born am on di 10 of June 1999 Almada, Setúbal District of Angolan Descent.
Leão join Sporting CP youth system at di age of 9 afta brief spell with Amora FC.
On 21 May 2017, still as junior, e make im senior debut with di reserves, e enta as second-half substitute and score inside di 1-1 away draw against S.C. Braga B.
On 1 August 2019, Leão sign five-year contract for A.C. Milan. He make im Serie A debut 24 days later, as 75th-minute substitute for Samu Castillejo. Im go later score im first goal as late consolation inside di 3-1 home loss to ACF Fiorentina on 29 September.
On 10 November 2017, at di age of 18, Leão win im first cap for di Portugal under-21 side, im play 31 minutes inside di 1-1 away draw against Romania for di 2019 UEFA European Championship qualifiers. He score im first goal for dat level on 10 September 2019, inside one 2-0 victory for Belarus for di 2021 European Championship qualification campaign.












