Total AFCON Tanzania 2019: Cameroon defeat Guinea to become U-17 champions

Wia dis foto come from, CAF
Cameroon don win di U-17 Total Africa Cup of Nations, afta 16 years.
Na afta 120 minutes for play weh deh win Guinea for penalty 5-3 for emerge champions for dis youth category.
De two sides for normal taim no fit score even as Guinea bin dominate de game. Cameroon miss plenti chance for 'mbunja' ball for net.
As de competition end, Steve Mvoue na de player for de competition.
President Paul Biya for tweet don congratulate de U-17 Lions as deh emerge champion for Africa Cup of Nations weh deh play for Tanzania.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Cameroon go for finals as favourites as deh bin first beat Guinea for group B 2-0 before deh meet again for Sunday finals.
Kontri for legends laik Roger Milla and Thomas Nkono wit only ten-man qualify for finals afta deh snatch win Angloa 4-3. Guinea Junior Sylis for Group A bin reach finals afta deh beat Nigeria 10-9 for penalty shoot -out.
Cameroon coach Thomas Libiih, weh e bin bi part of 1990 squad for Italia don achieve e dream for win de U-17 cup.
End of Di one wey oda users dey read well well
Celebration bi dey for stadium as Minister for Sports and Cameroon football federation join fans for celebrate win.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3