Italy 40 year-old legend Buffon go continue im ogbonge career for PSG, France

Gianluigi Buffon

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Gianluigi Buffon Juventus goal keeper never win Champions League
Read am in 1 mins

Paris St-Germain don sign sign former Juventus and Italy goalkeeper Gianluigi Buffon on free transfer.

Buffon, 40, comot Juventus at di end of last season, afta im end 17-year stay for di club wia im play for dem 656 times.

Rumour bin comot say di nine-time Serie A winner go still work Juve as back-room staff but now don sign one-year deal with di French champions with option to extend am for anoda 12 months.

"I know di kain dreams wey PSG and dia fans get for dia hearts," im tok.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

"I go bring all my energy, all my experience and all my thirst to win, to help my new club achieve all di great tins dem wan do for di future.

"For di first time in my career, I go leave my kontri and only project wey big like dis fit make me take dat kain decision."

Buffon bin finish last season for Juventus with seven career league titles back to back.

Im go join di new PSG head coach Thomas Tuchel for Parc des Princes and na im and Alphonse Areola go dey drag place as first team goalkeeper.