World Cup 2018: Neymar and oda players hairstyles wey dey make pipo scratch head

Neymar

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di hairstyle wey Brazilian player Neymar Jr. cari dey make pipo wonda say wetin dey happen?
Read am in 2 mins

Social media catch fire afta dem see wetin Neymar Jr. cari for head enta Brazil match against Switzerland on Sunday for di FIFA 2018 World Cup wey dey happen for Russia.

Di match finish 1-1 and many pipo feel say Brazil fall dia hand as dem be one of di teams pipo tink say go do well for di tournament so dem suppose beat di Swiss team.

But for internet, di mata move from di match to Neymar hairstyle.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

No be only Neymar cari hairstyle wey pipo dey put eye for dis World Cup.

Williams Ekong Troost

Williams Ekong Troost

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Na beta accessory for di Super Eagles beta jersey

Ekong bin get beta swag wen im dey slay wit im mohawk style for March but di new style na to rep Naija for World Cup.

Cho Hyun-Woo

Cho Hyun-Woo

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pipo dey compare Hyun-Woo hairstyle wit Neymar own

Pipo like di hair style wey Korean goal keeper Hyun-Woo sama for dis World Cup. But e not help im team win as Sweden beat dem for dia first match.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

Paul Pogba

Paul Pogba

Wia dis foto come from, Laurence Griffiths - FIFA

Wetin we call dis foto, Pipo say make Pogba leave hair mata and concentrate on football

Di one wey surprise pipo pass na di hair style wey France midfielder Paul Pogba cari go di tournament.

You go tink say as di Manchester United player barb normal hairstyle, pipo go comot face. Na lie.

E surprise pipo say Pogba, wey dey always like to add plenti orishirishi and jara for im hair, do normal hairstyle.

Skip X post, 4
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 4