Super Eagles coach Rohr don name im 23-man squad

Wia dis foto come from, Reuters
Super Eagles of Nigeria coach Gernot Rohr don name im final 23-man squad wey go go Russia World Cup.
Midfielder Mikel Agu and defender Ola Aina na di two players wey di coach drop from di 25 players wey bin remain.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Midfielder John Obi Mikel na im go captain di side wey never pass second round for di five times Nigeria don go World Cup.
Crotone striker Simeon Nwankwo, wey only don play one match for di Super Eagles for dia 1-1 draw with DR Congo on Monday follow make di list.
Nigeria 23-man squad:
Goalkeepers: Francis Uzoho (Deportivo La Coruna, Spain); Ikechukwu Ezenwa (Enyimba); Daniel Akpeyi (Chippa United, South Africa)
Defenders: William Troost-Ekong and Abdullahi Shehu (Bursaspor, Turkey); Tyronne Ebuehi (Ado Den Haag, Netherlands); Elderson Echiejile (Cercle Brugge KSV, Belgium); Bryan Idowu (Amkar Perm, Russia); Chidozie Awaziem (Nantes FC, France); Leon Balogun (Brighton, England); Kenneth Omeruo (Kasimpasa, Turkey)
Midfielders: John Mikel Obi (Tianjin Teda, China); Ogenyi Onazi (Trabzonspor, Turkey); Wilfred Ndidi (Leicester City, England); Oghenekaro Etebo (Las Palmas, Spain); John Ogu (Hapoel Be'er Sheva, Israel); Joel Obi (Torino, Italy)
Forwards: Ahmed Musa (CSKA Moscow, Russia); Kelechi Iheanacho (Leicester City, England); Victor Moses (Chelsea, England); Odion Ighalo (Changchun Yatai, China); Alex Iwobi (Arsenal, England); Simeon Nwankwo (Crotone, Italy)
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Super Eagles go play Czech Republic on June 6 for dia final friendly match before di World Cup to start.
Nigeria dey group D with Croatia, Iceland and Argentina.











