You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Real Madrid vs Liverpool: Who go win di Champions League?
Fans for di whole world don dey gather for different area wia dem go watch di UEFA Champions League final between Liverpool and Real Madrid
Who go win na wetin dey everybodi mind.
Real Madrid don carry di cup 12 times and Liverpool don carry am five times.
Wit star players like Christiano Ronaldo for Madrid and Salah for Liverpool di competition don already dey make fans select dia side.
Di starting line up don show sha.
Real Madrid (4-D-2) Navas; Carvajal, Varane, Ramos, Marcelo; Casemiro; Modric, Kroos; Isco; Benzema, Ronaldo.
Liverpool (4-3-3) Karius; Alexander-Arnold, Lovren, Van Dijk, Robertson; Wijnaldum, Henderson, Milner; Salah, Firmino, Mane.