You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Di goalkeeper wey say im 'one hand' no go stop am
Wen machine for wia im dey work cut one of im hand comot, dat one no make Victor Sani reduce im love for football.
Now, im be goalkeeper for Nigeria Special Eagles team and wen im no dey play ball, na im danfo bus im dey drive.
Sani na pesin wey dey hustle well-well for di streets of Lagos with im bus, to make sure say im dreams come true.
Di goalkeeper tell BBC Pidgin say im believe say one day im go make am like Messi and Cristiano Ronaldo.