Super Eagles: See foto dem of di Nigeria World Cup jersey wey everybodi dey talk about

Nike don release di jersey dem Nigeria Super Eagles go wear for Russia World Cup 2018 and everybodi dey talk about am.

Alex Iwobi

Wia dis foto come from, Nike/Twitter

Wetin we call dis foto, Alex Iwobi na one of di players wey dem use model di jersey wey look like di one Nigeria wear for 1994 World Cup.
Uche Okechukwu

Wia dis foto come from, VINCENT ALMAVY

Wetin we call dis foto, For USA 1994 World Cup, di Super Eagles reach di second round and di jersey dem wear look like di 2018 own.
Mikel Obi

Wia dis foto come from, NFF/Twitter

Wetin we call dis foto, Captain Mikel Obi wear di deep green jersey wey fine die.
Iwobi and models in Super Eagles jersey

Wia dis foto come from, Nike/Twitter

Wetin we call dis foto, Nike say dey wan 'tap into di attitude of di nation' with dis new jersey dem.
Models wey wear Super Eagles jersey

Wia dis foto come from, Nike/Twitter

Wetin we call dis foto, Super Eagles players like Mikel Obi, Alex Iwobi, Kelechi Iheanacho and Wilfred Ndidi show for di event. Nike also use some models take show di jersey dem.
Model wey wear Super Eagles green jersey

Wia dis foto come from, Nike/Twitter

Wetin we call dis foto, Di shirts na part of collection wey feature Fast Fit Vapotknit technology to help di players.
Model wey wear Super Eagles shirt

Wia dis foto come from, Nike/Twitter

Wetin we call dis foto, Nike say dem want di clothes to ginger di spirit of Naija.
Woman wey wear Super Eagles shirt

Wia dis foto come from, Nike/Twitter

Wetin we call dis foto, Nigeria dey Group D for di 2018 World Cup with Argentina, Croatia and Iceland.
Models wey wear Super Eagles jersey

Wia dis foto come from, Nike/Twitter

Wetin we call dis foto, Na for London na im dem show di world di jersey dem.
Model wey wear Super Eagles jersey

Wia dis foto come from, Nike/Twiiter

Wetin we call dis foto, Nike say di jersey dem no go dey available to buy until June 2018.
Iwobi and Wizkid

Wia dis foto come from, Nike/Twitter

Wetin we call dis foto, Nigeria superstar musician Wizkid follow show for di event.