Seven pictures as Arsene Wenger mark 811 Premier League matches

Arsene Wenger don create history as di manager wey get highest number of matches for English Premier League.

Arsene Wenger

Wia dis foto come from, Stu Forster

Wetin we call dis foto, Na for October 1996 Arsene Wenger become coach of Arsenal after di club sack Bruce Rioch wey been spend one year in-charge.
Wenger and Henry

Wia dis foto come from, SINEAD LYNCH

Wetin we call dis foto, For 3 August 1999, Arsene Wenger sign Thierry Henry wey go be one of di most important signings for im career. Henry go become di highest goal scorer for Arsenal history.
Arsenal

Wia dis foto come from, Clive Mason

Wetin we call dis foto, For di 2003-2004 season, Wenger lead Arsenal to win di league and im team no lose any match for di whole season. People call dem 'Di Invincibles'.
Emirates stadium

Wia dis foto come from, Tom Shaw

Wetin we call dis foto, Arsene Wenger dey in charge as Arsenal move from dia Highbury stadium, go di new Emirates stadium wey dey close by. Tori be say im hand dey well-well for di design of di new stadium.
Ferguson and Wenger

Wia dis foto come from, Matthew Peters

Wetin we call dis foto, Na Alex Ferguson, Wenger go take over from as coach with most matches for Premier League. Ferguson set record of 810 matches as coach of Manchester United, but Wenger don pass am with 811 matches.
Scoreboard Manchester United 8 Arsenal 2

Wia dis foto come from, ANDREW YATES

Wetin we call dis foto, One of di lowest points for Wenger career for Premier League na when im Arsenal team lose 8-2 to dia rivals Manchester United for 2011.
Wenger and Mourinho

Wia dis foto come from, ADRIAN DENNIS

Wetin we call dis foto, Wenger career for Premier League no go complete without picture of him and Jose Mourinho, as dem no like demself at all at all.
Banner of Wenger out

Wia dis foto come from, LINDSEY PARNABY

Wetin we call dis foto, Some Arsenal fans want make Wenger comot for di club, and some even protest say make im go.