TELL US YOUR STORY: How your life don dey affected by increase in food prices?
Families around di world dey struggle with cost of living crisis and 71 million pipo for developing kontris don fall into poverty as a result of di rise in food prices, according to di UN. Food prices and food scarcity don force families to skip meals, e don see dem switch to cheap ingredients and e don make dia physical and mental health worse.
You and your family don dey directly affected by di rising food costs? Tell us how your life don change - if your story dey selected, one of our journalists fit contact you soon.