Informate on di 2019 Presidential Candidates
Dis na tins wey you suppose sabi about di candidates.
- PartyPeoples Democratic Party (PDP)Born Date25th November 1946, Jada, Adamawa state.Bio
- Businessman and politician.
- Former Vice President of Nigeria 1999 - 2007.
- E contest and lose presidential elections for 2007 under Action Congress (AC).
- For 1998 dem elect am as Governor of Adamawa State. During di time im be Governor-Elect dey wait swearing in, Peoples Democratic Party (PDP) Presidential candidate Olusegun Obasanjo choose am to be im running mate. Di two of dem later come win elections for February 1999, and on 29 May 1999, Abubakar become di second vice president wey Nigerians go vote enta office.
- E contest for di office of govnor of di old Gongola state (now Adamawa and Taraba states) for 1991 and lost.
- E contest for Presidency for 1993, but e carri third for di Social Democratic Party primaries.
- Officer for di Nigeria Customs Service for 25 years, 1964 - 1989.
- PartyAlliance for New Nigeria (ANN)Born Date12th May 1971 Ibadan, Oyo state.Bio
- Business consultant and public speaker.
- Im dey train oga of companies wey get operation across Africa ontop Ethical leadership for di Seed Program wey Stanford University dey do.
- Im na di CEO of leadership development institution, Gemstone Group.
- PartyYoung Progressive Party (YPP)Born Date7th May 1963 for Lagos state.Bio
- Lawyer and economist.
- Former CBN Deputy Governor from 2009 to 2014 and member of di Monetary Policy Committee.
- Moghalu na political affairs officer for di Department of Peacekeeping Operations for UN Headquarters for New York 1996 - 1997.
- Im na di legal adviser to di United Nations International Criminal Tribunal for Rwanda for 1997 and later get promotion to be di spokesman for di international tribunal.
- Dem appoint am as di Head of Global Partnerships and Resource Mobilization for di World Health Organisation.
- PartyAll Progressive Congress (APC)Born Date17th December 1942, Daura, Katsina state.Bio
- President from 2015 till today.
- Chairman of Petroleum Trust Fund, 1994.
- Former military Head of State 31th December 1983 - 27th August 1985.
- Im contest for di office of president of Nigeria for 2003 and 2007 under di All Nigeria People's Party (ANPP) but President Olusegun Obasanjo of di People's Democratic Party (PDP) defeat am.
- Congress for Progressive Change (CPC) Presidential candidate for di 2011 and im lose to incumbent President Goodluck Jonathan of di PDP .
- Federal Commissioner for Petroleum and Natural Resources 1976 - 1979.
- Governor Borno state February - March 1976.
- And im serve as Govnor of Northeastern state 1975 - 1976.
- PartyAfrican Democratic Congress (ADC)Born Date24th December 1956 for Randa, Sanga, Kaduna state.Bio
- Economist, Banker and International Development Specialist.
- Former Deputy Govnor, Central Bank of Nigeria 2005 - 2007.
- Im na Special Adviser to President Jonathan on Economic and Policy Matters, member of di Economic Management Team and Official of di African Development Bank Group.
- PartyAllied Congress Party of Nigeria (ACPN)Born Date28th April 1963 for Anambra state.Bio
- Chartered Accountant and economist.
- Vice-President of di World Bank, Africa division 2007 - 2012.
- Minister of Solid Minerals 2005 - 2006.
- Minister of Education 2006 - 2007.
- Nominee for di 2018 Nobel Peace Prize.
- Co-Founder for Bring Back Our Girls Campaign and Transparency International.
- PartyAfrican Action Congress (AAC)Born Date16th February, 1971 for Kiribo, Ondo state.Bio
- Journalist, activist and Publisher.
- Im start one online media company Sahara Reporters for 2006 to promote Africa culture, values and to torchlight corrupt government way.
- Student Union leader for University of Lagos.
How we take select
We select di Presidential candidates based on tins like:
- Parties for parliament.
- Popular parties (wey dia candidates no dey popular).
- Popular candidates from party wey pipo no too sabi
- How dem take strong for media.
- How dem take strong for social media.
Who get di foto
Getty, www.fela2019.com, atiku.org, tobuildanation.com, facebook, sowore2019.org
Who do am
Olawale Malomo develop am. Nkechi Ogbonna do di research




