Gen. Sani Abacha
Di main tori wey happun for di life of di late dictator
E don reach 20 years since Nigerian military ruler Sani Abacha die.
Na wit iron hand im bin take rule Nigeria and plenti human rights wahala full im goment.
Even till today, Abacha na pesin wey still dey cause kwanta for im kontri. President Muhammadu Buhari, wey imsef be former military ruler, don hail am for di ogbonge tins wey im do like roads wey im build, education and health.
See as di life of di late dictator take waka
- 20 September1943
Kano, Nigeria
Na for Kano State, northern Nigeria dem born General Sani Abacha. - 1963


Im finish school for di Nigerian Military Training Centre for Kaduna den do more training for UK. - 1965
Nigeria
Im marry Maryam Jiddah. Dem born 10 pikin, but one of dem come later die. - 1967-72
Southern Nigeria
During civil war for Nigeria, Abacha fight for di federal side against Biafra and im continue to dey chop express promotion for army. - 1983
Lagos, Nigeria
Im name first enta di mouth of Nigerians sake of im connect wit di 31 December coup wey comot civilian Presido, Shehu Shagari. Gen Buhari na di next pesin wey wear di cap as military ruler. - 1985
Lagos, Nigeria
Na wit force dem comot Gen Buhari for coup wey Abacha support. Im help Gen Ibrahim Babangida takeover and dem uprade am to major general. - 12 June1993
Lagos, Nigeria
Dem do democratic elections wey military bin don dey promise tey tey. Early results show say na rich businessman Moshood Abiola dey win but Gen Babangida do u-turn cancel di result wey vex Nigerians. - August1993
Abuja, Nigeria
Abacha upgrade to Minister of Defence afta Babangida, wey resign later, make Ernest Shonekan civilian presido in charge of goment for di main time. - 17 November1993
Abuja, Nigeria
Shonekan resign afta im cari im power give Abacha. Sabi pipo suspect dis u-turn na anoda coup. Abacha rule boku wit human rights wahala and di way im harsh on top opposition. - 1994
Nigeria
Moshood Abiola, wey many Nigerians believe win di 12 June election, crown imsef president for Lagos and na dis land am for prison. - 1995
Ogoni, Nigeria
Abacha goment chop black eye afta dem condemn am all over di world and dem collect suspension from Di Commonwealth afta dem execute di Ogoni Nine, wey be activists wey dey protest di bad bad tins goment and oil big boys Shell dey do. Among di activists wey die na writer and Nobel Prize nominee Ken Saro-Wiwa. - 1996
West Africa
Dem choose Abacha as chairman for di Economic Community of West African States (Ecowas), wey be economic join-body for di region. - February1998
Sierra Leone
Abacha send Nigeria military go Sierra Leone wit mission to comot di military goment wey tanda for dia afta dem bin comot civilian goment one year before den. - 8 June1998
Abuja, Nigeria
Abacha die unto suspected heart attack and dem bury am for di same day. Nigeria begin journey go meet democracy one year later.
Di work of:
Yemisi Adegoke na im produce am
Olawale Malomo sidon on top development
Olaniyi Adebimpe na di desgin wizkid
Foto: AFP, Getty Images, Nigeria High Commission.
Share dis page
More from BBC News Pidgin

