Taiwo and Kehinde Apelehin on how dia different skin colour dey make pipo ask questions

Dis na some of di reaction wey Kehinde and Taiwo Apelehin don ansa since dia mama welcome dem into dis world 25 years ago.

Di twins wey come from Lagos trend for Nigeria afta dem share dia birthday foto on social media wey make pipo shock say dem no look alike.

Taiwo and Kehinde say dis no be di first time dem dey get dat kain reaction from pipo even when dem dey young.

Di unidentical twins say dem still get wetin make dem look alike

Taiwo and Kehinde say even as dia colours dey different, dem still get physical features wey pipo go use sabi say dem be twins.

"Wen pipo look us well-well, dem go say our nose dey same o, some go even agree say we get di same kain body structure," dem tok.

"Dem go always be like, even you look dem well, you go sabi say dem be twins".

Producer: Olaronke Alo, Video Producer: Video journalist: Dan Ikpoyi