Ukraine-Russia war: Ukraine, Libya, Iraq - See timeline of five major invasions

Ukraine-Russia war 2022 enta one week on Tuesday 2 March.

More explosions dey reported overnight inside di Ukrainian capital and oda cities around di kontri.

Russia bin launch one major military assault against Ukraine early Thursday 24 February, 2022.

President of Ukraine Volodymyr Zelensky say di next 24-hours go dey "crucial" for dem.

Sunday bin hard for di Ukrainian forces as Russian troops continue to throw shellings from almost evri corner.

Dis na wetin any kontri wey dey face powerful invasion dey face.

Apart from Ukraine-Russia war, BBC Pidgin bring you time line of five oda big invasions wey shake di world.

Ukraine-Russia war: Ukraine, Libya, Iraq - See timeline of five major invasions [Ukrainian President Volodymyr Zelensky on front line]

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, President Volodymyr Zelensky for di front line

Latest news on Ukraine-Russia war

Before we begin look at history, make we quickly recap di Ukraine-Russia war so far.

By air, land, and sea, Russia don launch one deadly attack on Ukraine.

Intense fight-fight continue all through di weekend, as Russian forces dey target cities for inside Ukraine.

But dem fail to hold di city Kharkiv, for di northeast of di kontri, wey be Ukraine second largest.

However, di assault from Russia dey continue from all from almost all directions.

And tori be say Kremlin forces dey make better progress from di south, besieging di port cities of Kherson and Berdyansk, on two parts of di Black Sea.

Ukrainian President Volodymyr Zelensky announce plans to meet one Russian delegation for di Ukrainian-Belarusian border afta tok-tok wit Belarus leader Alexander Lukashenko.

Dem neva offer timeline and di situation still neva clear, as Belarus dey support Putin invasion.

Ukraine na one European democracy of 44 million pipo.

Russian forces and dia forces dey for di outskirts of di capital, Kyiv.

For months, President Vladimir Putin bin deny say e go enter im neighbour.

But on Thursday 24 February, Putin tear up one peace deal, and send forces across borders for Ukraine north, east and south.

Read on to see a timeline of five oda major invasions wey don shake di world before.

Iraq invasion of Kuwait

Ukraine-Russia war: Ukraine, Libya, Iraq - See timeline of five major invasions

Wia dis foto come from, COLIN DAVEY/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, BA flight 149 wey dey destroyed

Di Iraqi invasion of Kuwait be one operation conducted by Iraq for 2 August 1990, where dem invade di neighboring State of Kuwait.

And di invasion bin lead to seven-month-long Iraqi military occupation for di country.

Di invasion and as Iraq bin no gree to withdraw from Kuwait by deadline wey di United Nations give dat time bin lead to one direct military intervention by one United Nations-authorized coalition of forces wey United States bin lead.

Di events dey known as di first Gulf War, wey later lead to forced expulsion of Iraqi troops from Kuwait and di Iraqis bin sett 600 Kuwaiti oil wells for fire during dia retreat.

Afta den, for many years e bin get one kwanta and mystery wey surround di landing of BA flight 149 for Kuwait during one Iraqi invasion for 1990.

E start wit di claim say di UK government dey use am for secret mission.

Dis one den lead to passengers and crew suffer suffer and abuse for captivity for five months for 2021.

Israeli-Palestinian crisis

Ukraine-Russia war: Ukraine, Libya, Iraq - See timeline of five major invasions [Israeli Palestinian war]

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Israeli Palestinian war

Di Israeli-Palestinian ksala be one of di world most enduring conflicts.

Na sake of how Israel bin occupy di West Bank and Gaza Strip wey don reach 54 years of conflict.

World powers bin make various attempts to settle di conflict as part of di Israeli-Palestinian peace process.

Tension bin grow to sectarian conflict between Jews and Arabs afta di implementation of di Mandate for Palestine.

Di mandate include one binding obligation on di British goment to "establish one national home for Jewish pipo in palestine".

Attempts to solve diearly conflict for di 1947 United Nations Partition Plan for Palestine and di 1947-1949 Palestine war, bin mark di start of di wider Arab-Israeli conflict.

Di current Israeli-Palestinian status quo start afta Israeli military occupy di Palestinian territories for di 1967 Six-Day War.

Iraqi invasion 2003

Ukraine-Russia war: Ukraine, Libya, Iraq - See timeline of five major invasions [Iraq war]

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Hundreds of thousands pipo bin march through London in opposition to military action in Iraq

Di American invasion of Iraq for 2003 dey partially seen as one legacy of di 1991 Gulf War.

Di United States bin first enter war wit Saddam Hussein for 1991 to force im invading armies out of Kuwait.

At di end of di Gulf War, one truce wey leave Saddam Husseinfor power bin dey signed.

Di truce dey sealed by di United Nations wey bin establish di conditions wey America go allow Saddam Hussein to retain im position as Iraq president.

Di UN bin list wetin dem want ,dem callam resolutions, wey require make Saddam Hussein to disarm and to stop im programs to develop weapons of mass destruction (WMD).

Dis weapons include nuclear, biological, or chemical weapons wey dey able to cause serious kasala and loss of life.

Without army stay for Iraq, di UN bin no dey able to make Saddam Hussein obey dia agreement.

E bin get round di economic sanctions wey dem sama am, interupt di UN inspectors, and avoid di terms wey dem agree until finally,for December 1998, e bin throw di inspectors out of Iraq join.

In response, President Clinton den fire 450 missiles enter Iraq. E dey known as Operation Desert Fox.

Hundreds of thousands of people wey di organisers estimate to be almost two million bin march through London against military action for Iraq.

President Clinton bin also beg Congress to pass di Iraqi Liberation Act (ILA), wey give di American President di go-ahead to use military means to helep di Iraqis wey dey try overthrow Saddam Hussein.

President Clinton den warn goments around di world about di serious threat Saddam Hussein show to international peace, and di USA called bin call for im removal from office.

You fit also read:

Ukraine-Russia war: Ukraine, Libya, Iraq - See timeline of five major invasions

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Libya bin tear sake of violence from 2011 afta Col Muammar Gaddafi dey deposed

Libya Invasion

For 19 March 2011, one multi-state NATO-led coalition begin one military intervention for Libya.

Di reason be to implement United Nations Security Council Resolution 1973, wey be answer to events during di First Libyan Civil War.

American and British naval forces bin fire over 110 Tomahawk cruise missiles, while di French Air Force, British Royal Air Force, and Royal Canadian Air Force bin undertook sorties across Libya and one naval blockade by Coalition forces.

French jets bin launch air strikes against Libyan Army tanks and motor. Di intervention no employ foreign ground troops.