Professor of snake: 'Na di same snake wey pipo dey fear dey put food on my table'
Meet Prof. Edem Archibong Eniang di 'professor of snake'.
Prof. Edem Archibong Eniang na lecturer for di department of forestry and wildlife for di University of Uyo, Akwa Ibom state for Nigeria.
E don dey teach about am for over 20 years now.
For dis exclusive interview wit BBC Pidgin, E tok about im love for snake plus wetin you suppose do wen snake bite you or if you jam am face to face.