'Davido and Chioma don come back together?' Fans ask afta fotos of dem two comot

Wia dis foto come from, Davido/Chiom
Video and foto of Nigeria afrobeat singer, Davido and im baby mama Chef Chioma don come out and e dey make social media users react.
Dis na di first time for a long time wen di two celebrities go dey together inside recent photo.
Tori bin come out say David Adeleke, wey pipo know as Davido and Chioma Avril Rowland, wey pipo know and dey call Chef Chioma dey quarrel.
BBC Pidgin no fit confam di tori as di two pipo neva tok any tin for public about how dia relationship dey.
But di video and foto of Davido and Chioma wey dey go viral happun for di second birthday of dia son - Ifeanyi.
Di two celebs turn up to celebrate dia son wey Chioma born for October, 2019.
On October 20, Davido bin post birthday wish for Instagram wia im shower Ifeanyi wit prayers.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
How pipo react for social media
Di Nigerian singer on social media dey known as celebrity wey dey close to im children as im no dey fail to flaunt dia pictures online.
But dis foto of im and Chioma dey make dia fans happy.

Wia dis foto come from, @ThaGuru_

Wia dis foto come from, Screengrab/Facebook
One former reality show housemate @giftypowers for her reaction describe Davido as "good papa".

Wia dis foto come from, @giftypowers

Wia dis foto come from, Screengrab/Facebook

Wia dis foto come from, @_Faves






