Usifo Ataga: Court rule say Chidinma Ojukwu get murder case to answer

Michael Usifo Ataga murder case:

Wia dis foto come from, OTHER

Wetin we call dis foto, Michael Usifo Ataga

Chief magistrate court for Yaba, Lagos south west Nigeria, don rule say Chidinma Ojukwu di alleged killer of di Super TV boss Usifo Ataga, go face trial for murder for di Lagos State High Court.

Di magistrate make di ruling wen Chidinma and oda suspects appear before di Chief Magistrate court Yaba on Monday, 6, September, 2021.

Di court also rule say di second suspect, Adedapo Quadri go also face murder trial, while Chidinma sister Chioma Egbuchu go face trial say e dey in possession of stolen item sake of say dem see di victim Usifo Ataga phone for her hand.

Di magistrate Adeola Adedayo base her ruling on advise from di Directorate for Public Prosecution, DPP.

Last time wey di mata enter court, di magistrate adjourn sake of say dem wan get DPP advise, now DPP don confam say cases dey for di suspects to face from conspiracy to commit murder to murder case plus conspiracy to commit forgery and odas.

Di case go now move over to di high court for trial of di suspects wey dia names appear for di DPP advise book.

Di magistrate adjourn di case till September 29, 2021 to get information of how and wen di case go waka for high court.

Na for June 2021 police bin discover di Super TV CEO dead body inside one short let apartment for Lekki Lagos.

Days later, police arrest 21-year-old Chidinma wey be university student after dem begin search for one female suspect for di mata.

Dangerous high profile murder cases like dis (Michael Usifo Ataga death) dey happun from time to time for Lagos.

For December 2019 one domestic staff connive stab MD of Maersk Nigeria, kill im wife for Lagos.

Who be Michael Usifo Ataga

Michael Usifo Ataga Burial: SuperTV CEO murder for 'Airbnb' domot - Nigeria Police confirm killing

Wia dis foto come from, Michael Usifo Ataga

Wetin we call dis foto, Michael Usifo Ataga, na Super TV Nigeria CEO until im alleged murder.

Michael Usifo Ataga don be Chief Executive Officer at Super Network Limited since April 2014 until im murder, according to im LinkedIn profile.

SuperTV, na wetin dem call Super Network Company wey be Over-The-Top [OTT] media streaming entertainment company for Ikoyi, Lagos.

Michael Usifo Ataga get wife and children wey report say dem base for Abuja.

Late Ataga, wey im life end at 50 years of age, bin attend University of Benin between 1988 and 1995.

Dem bury Ataga on July 30, 2021.

Who be Chidinma?

Chidimma Adaora Ojukwu na 300 level student of di University of Lagos Unilag.

She bin dey study mass communication for University of Lagos, according to di police.

She dey live wit her parents for Alagomeji area for Yaba Lagos.

Na for dis her parents house police say dem arrest her.

Chidimma be native of Abia state for south east Nigeria, according to wetin she tell tori pipo.

University of Lagos tok-tok pesin Nonye Oguama bin confam to BBC Pidgin say, di alleged murder suspect na dia student.

Until dis alleged murder investigation, Chidimma Ojukwu bin dey run part time studies for Unilag, Mrs Oguama tok.

Lagos police command say dem arrest Chidimma for her parents house..