Actress Chioma Grace confession video: Lynda Clems reply Ifemeludike Instagram viral video

Actress Chioma Grace confession video Apostle Johnson Suleiman, Lynda Clems: Ifemeludike Instagram video

Wia dis foto come from, Ifemeludike/Instagram

Actress Chioma Grace Ifemeludike say 'dis na my truth' for her confession video wey don go viral across Nigeria social media.

So wetin dey inside dis 12-minute-video wey di Nollywood actress release on Saturday?

Here na di summary of di shocking viral video confession wey BBC Pidgin don watch .

Actress Chioma Grace confession video Apostle Johnson Suleiman, Lynda Clems: Ifemeludike Instagram video

Wia dis foto come from, Instagram/@ifemeludike_

Wetin we call dis foto, Chioma Grace

Actress Chioma Grace confession video: Wetin we learn

Actress Chioma Grace Ifemeludike release di video on her Instergram page on Saturday 21 August.

She narrate how her fellow actress arrange runs for her to see one man on 20th of November 2016.

Di actress say she no too sabi di man dat time as di tin na quick arrangement.

Actress Ifemeludike add say she and di man allegedly have sex, claim wey BBC Pidgin no fit verify.

Di actress wey arrange di meet up say dem dey go meet her family friend wey dey go America. She tok.

She claim for di confession video say after dem knack, di man sharpaly give her im number.

'E say make I call am and not tell my friend.' Actress Chioma Grace Ifemeludike yan for di video.

She alleged say di man bin give dem bundle of money wey go reach like 500 thousand naira

And she and dis her friend split di money take her own share.

She say di money sweet her belle as she just graduate from school dey wait NYSC and she dey broke.

Chioma Grace Ifemeludike later tok for di video say she be see di man for social media dey help pipo.

Na dia she come confam say na him be di same man wey knack am.

But she no fit ask her friend sake of e fit dey risky. Di actress add.

Chioma Grace say she later ask her friend wen she go drop am off say who be di man?

She tell di friend say e look like one man of God wey dey popular.

But her friend say di man no be who she think, say im be her family friend.

But she no too tok since she get di man number.

She even allege say she bin see di popular clergyman again.

And di man even wan help her wit NYSC posting but e no work. She tok.

According to her, di two of dem bin allegedly meet again to have sex for one big hotel inside Lagos.

Di actress form born again inside dis video wey she publish for her Instagram page.

She say di reason why she do di confession video be say she don become born again.

But all dis allegations dey subject to verification wey di actress gats provide proof.

Dis no be di first time wey matter of public interest like dis don shelle for Nigeria.

In di past, many of dem dey eventually die down because of lack of proof.

Actress Chioma Grace Ifemeludike however add say she dey always feel bad.

Particularly, anytime wey di clergyman name commot for somewia wey dem dey accuse am of sometin.

Di actress say e dey difficult for her to come out sake of her family.

But now she dey ready to tok true sake of di sin no be for her body alone but Christ body. Di Actress conclude.

Those wey she accuse fit respond to di confession video later.

In di meantime, di matter don become rising social discuss for Nigeria as e involve a man of God.

Actress Chioma Grace confession video Apostle Johnson Suleiman, Lynda Clems: Ifemeludike Instagram video

Wia dis foto come from, Instagram/@ifemeludike_

Wetin we call dis foto, Chioma Grace

Actress Chioma Grace confession video: Lynda Clems reply accuse

Actress Lynda Clems, wey be one of di names Chioma Grace Ifemeludike viral confession respond.

Clems wey reply for one post say she no get idea about wetin Actress Chioma Grace dey tok about.

She say " I no be anybody pimp, I never be and I no go be. Dis one dey absurd.

"No mention my name for dis kind manner again or I go take legal action, dis one no dey acceptable."

Chioma Grace Ifemeludike profile

Chioma Grace Ifemeludike na Nigerian actress, filmmaker and humanitarian.

She don appear for some naija movies like - Painful Truth, Commissioner For Happiness.

She also act A big Nwa, Di Gods must hear dis, plus more.

Dem born Ms Ifemeludike on July 9, 1992 for Jos Plateau state north-central Nigeria.

But her state of Origin na Anambra state for south-east Nigeria.

Her papa bin die wen she dey young so na her mama raise her.

Ms Chioma bin create one YouTube series wey im title be Corpers Heaven.

She say na during her NYSC service days she bin get inspiration to start dat one

Di young actress bin start her career by creating drama-related content until dem discover and cast her for film.